Naijeria, Wi Hail Dee

Naijeria, Wi Hail Dee
national anthem
KontriNaija Chenj-am
Language of work or nameNigerian English Chenj-am
First lineNigeria we hail thee, our own dear native land, Chenj-am
Last lineAnd so with peace and plenty Nigeria may be blessed. Chenj-am

"Naijiria, Wi Hæil Dee" na di niu nashonal antem of Naija. Dis niu anthem na im dey yuz wen Naija get dia indipedet in 1960 go rish 1978. In 2024, Naija kom stil bigin to yuz am again. Di sekod antem of Naija "Arais, O Kompatriots," na im Naija pipo dey yuz wen dem chenj Naijiria, Wi Haeil Dee nashonal antem to Arais, O Kompatriot. Arais , O Kompatriot bigin in 1978 an Naija pipo stop to dey yuz am in 2024.[1][2]

Histori

chenj-am

"Naijeria, Wi Hail Dee" been dey in yuz as di fes nachonal antem for Oktoba 1, 1960.[3] Lilian Jean Wiliams, wey bi wan British expatriaet wey dey liv for Naijeria wen dem grant am independens bi di pesin wey kompoes di liriks of di antem.[3] Frances Berda kompoes di miuzik for "Naijeria, Wi Hail Dee."[3]

Di sekond nachonal antem, "Arais, O Kompatriots," replaes "Naijeria, Wi Hail Dee" for 1978.[3]

Naijeria wi hail dee

awa own dear netiv land

Though traibs and tong dey difa

In brodahud wi stand

Naijerians aul, dey praud to sav

Awa sovereign Modaland.

Awa flag ga bi a simbol

Say trut and justis reign

In peas or batul honour'd,

And dis wi kaunt as gain,

To hand on to awa pikin-dem

A bana witaut stain.

O God of aul kreashon

Grant dis awa wan request.

Hep us to biuld a neshon

Whe no man dey oppresd

And so wit peas and plenti

Naijeria fit dey blesd.

Kriticisim

chenj-am

Wen "Naijeria, Wi Hail Dee" fes dey anaunsd, di niu nachonal antem fais kriticisim for a nomba of reasons. Di Deili Savis, wey bi newspaepa wey Yoruba oganaizashon Egbé Ọmọ Odùduwà dey prodius, start a rebelious kampaign against di nachonal antem, wey risolt to di fomaeshon of a komiti to kolet signaechos as a petishon.[4]

Referens

chenj-am
  1. "Naijeria Nachonal Antem Komposa, Pa Ben Odiase, kpai". Gazele News. 2013-06-12. Archived from the original on 2017-09-27. Retrieved 2024-01-31.
  2. "Nigeria national anthem lyrics: Lillian Jean William wey write 'Nigeria We Hail Thee' - who she be?". BBC News Pidgin. 30 May 2024. Retrieved 2024-09-19.
  3. 3.0 3.1 3.2 3.3 "Gudnait, Pa Benedit Odiase (1934 – 2013)". National Mirror. 2013-06-30. Archived from the original on 2013-07-04. Retrieved 2024-01-31.{{cite news}}: CS1 maint: unfit URL (link)
  4. Mphahlele, Ezekiel (1960). "Naijeria on di Eve of Independens". Afrika Today. 7 (6): 4–6. JSTOR 4184128.